Meet Richard Appiah di Ghanaian footballer wey court sentence to l!fe imprisonment.
According to di Tori, una brother Richard bin kpai two boys for hin house in 2021, di name of di boys na Louis Agyemang wey dey 12 years and Stephen Sarpong wey dey 15 years.
Police see as e pieces one pikin deadi bodi come store am inside fridge while di second boy bodi still dey inside in room.
When dem ask am una brother say e do am oo but e no know when e do am say e bin get mental problem asin e get skusku for head.
Court say lie lie e purposely do am so dem don sentence am to l!fe in prison make e go life di rest of hin life inside kirikiri with hin blue/green agbada.
My people shey di judgement dey okay ?