You Block Me I Block You - 2wks ago

Image Credit: Beckham family

My people make una come oo, David Beckham pikin don scatter hin family table because of w0man🤣 • Brooklyn Beckham wey be Beckham first son bin get issue with hin parents wey make dem block each other although Brooklyn tok say na hin parents first block am while hin parents say na him block dem first. • Di issue go far wey make Brooklyn tell hin parents say if dem won follow am tok make dem meet hin lawyer say e no won dey tok to dem again. •Now di bobo don come out tok say wetin make am dey get issue with hin parents na because of how hin parents take dey treat hin wife and how hin parents won take spoil hin marriage. • Brooklyn Beckham say na hin mama suppose sew hin wife wedding gown in 2022 but she suddenly change her mind when di wedding don already reach wey make dem begin find another fashion designer for eleventh hour. • Di bobo say on that wedding day, him and MC don play say dem go call am make e come dance r0mantic dance with hin wife. • Di bobo say as MC call am naso hin mama rush come stage come begin dance with am dey rock am dey give am robo say di way hin mama take dance with am for public di inappropriate and di thing vex am and hin wife. Brooklyn say make hin family avoid am make e enjoy with hin wife , e say e no won settle with them make dem leave am alone. My people una say wahala be like wetin?🤣

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message