Why Nigeria Still Dey Struggle Wit Insecurity Despite High Security Spending - 7 hours ago

Govment go, govment come and year in, year out, defence and security budget dey take di highest percentatge share of Nigeria budget. But why insecurity neva get solution?

Dis na big kwesion plenti Nigerians and sabi pipo don dey ask for many years, as insecurity dey hit deep into Nigeria.

President Bola Tinubu bin present 49.7 trillion naira proposed budget to di National Assembly, and out of dat, 4.91 trillion naira na for defence and security for 2025.

Di 2026 budget wey worth 58.18 trillion naira, security and defence get di highest share of wit 5.41 trillion.

By April 2026, Nigeria President Tinubu sign di 2026 appropriation bill wey provide for how dem go spend 68.32 trillion naira, and still security get better per centage share for inside.

Nigerian teachers protest abduction of schoolchildren and teachers as victims still dey captivity for ova two weeks

Dis confam say, year in, year out, Nigeria get per centage of di. budget from taxpayers money wey dey go into security and defence, but di wia e dey go.

Despite years of military operations, rising defence budgets, and repeated goment interventions, insecurity remain one of Nigeria most pressing challenges.

Wit di latest abduction of schoolchildren and dia teachers for Oyo and Borno states sparking serious questions and leading to protests, how long Nigeria go battle insecurity?

One report mention say wetin dey drive militants na ideological, political and territorial goals, wey make dem dey use beta planned and sustained kasala.

Anoda report wey di geopolitical research firm, SB Morgen (SBM) Intelligence, bring come outside tok say Nigerians don pay at least $1.66m give kidnappers between July 2024 and June 2025 and e don make "banditry" to be like beta business.

Sabi pipo say collection of ransom na one reason wey make terrorist dey attck and kidnap pipo for Nigeria.

Dem say di killings dey normally happun for di attacks demsef and bandits dey also kill pipo wey dia familes no fit pay ransom.

Dr Buhari Ubandawaki wey be monitoring and evaluation expert, wit years of experience working wit Non-governmental organisations, identify multiple factors behind di rising attacks by bandits and Boko Haram for Nigeria.

E link di trend of terrorist and bandit attacks to financial incentives and military pressure.

“Wetin dey ginger dis criminal groups na di ransom wey dem dey get wen dem kidnap pipo so dem gatz dey run dia attacks against villages, travellers, churches and schools.”

E add say jaguda pipo get long term goal and na all dia attacks na to forward dia worldview, and if Nigeria wan defeat dem or atleast reduce dia attacks, dem gat move wit intelligence.

For di issue of military spending and why attacks dey hit more for Nigeria, Captain Garba wey be retired military officer tell BBC News Pidgin, say di defence and security budget for Nigeria gatz dey accounted for.

Oga Garba say no be to just approve budget for security, but di relevant authorities gatz also see say dem monitor to confam weda wetin dem approve dey used for di right course.

“Nobody dey doubt di patriotism or di honesty of di security chiefs, but di issue be say dem suppose do oversight. Sometime, misapplication fit dey of wia dia fund dey go.”

"If dem no appropriate di budget well, e fit no dey enough. One of di problem be say we tok about budget, budget dey high but wetin dem dey spend di budget on," retired captain Garba ask.

Anoda issue wey di retired senior military officer tok na if dem dey check di security budget to confam say dem dey spend am ontop wetin e dey for.

“If di Senators no ready to examine, den issues dey, dem no dey do am for any democracy, check di America, check di British, if dem give pipo taxpayers money, you gatz check dem.”

E say if Nigeria wan face di insecurity wahala for di kontri, both di executive and legislative need check, instead of increasing di defence budget evri year witout producing results.

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message