My people make una come settle matter because I don settle tire i say make I carry am come una table.
• Meet Vladyslav Heraskevych di Ukrainian skeleton racer wey suppose represent Ukraine for 2026 Winter Olympics and e get better chance of winning but dem disqualify am.
• Before di competition, IOC warn say make people no carry anything pol!tical statement for di Olympic venues.
• E remain some mintues make di competition start na hin International Olympic Committee tell Vladyslav say dem don disqualify am for di competition.
• Di bobo ask wetin e do na hin dem tell am say dem disqualify am because of pictures wey dey for hin helmet.
• Di bobo say di pictures na pictures of Ukrainian athletes and coaches wey kpai during di time wey Russia bin dey f!ght Ukraine na why e won remember dem today.
•IOC later tell am oya make e wear black armband or find another way remember dem di bobo no gree say if no be that helmet e no go remember dem.
Naso dem tell am oya dey go your house na because we no go allow you wear am here naso dem disqualify am oo.
Hin papa don cry tire, even Ukraine president don come out condemn wetin IOC do, my people wetin how we go blame for this matter?