How You Take See The Sentence E Dey Okay Abi Too Short - 2wks ago

Image Credit: Jordan

Court don finally sentence one w0man wey use ogogoro eye spoil one footballer career.

Wetin happen be say, on di 1st February 2025, one Bashley FC and former Bournemouth player(Jordan Chiedozie) bin dey come back from training oo as di bobo dey drive go house naso hin tyre burst .

As di Tyre burst di bobo come down dey check am naso one car from nowhere h!t am come give am serious injUry wey make dem cut hin right leg commot even hin left leg get issue too.

As police come, e come be say na w0man dey drive di car and di name of di woman na Anna Bogusiewicz, dem come check madam car madam dey drink ogogoro dey drive and she don high join naso Chiedozie career take end. 

Fast forward to today, court don sentence di w0man to 2-years and four months in prison because she plead guilty.

Dem still give her three years driving ban, which means if she come out she go serve di ban and before she drive her again dem go do her test again.

My people shey di sentencing dey okay?

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message