African Giant Dey Shy To Host Just Hmmmmm - 2wks ago

Image Credit: BTC

The truth be say after this 2025 AFCON  Morocco go still host another one because that country really mean business 😅

• Na dem host last U-17 w0men’s Worldcup and na dem go dey host am till 2029( 5 times in a row)

• W0men’s AFCON na still dem host di last edition na dem go still host this one.

• Na Guinea suppose host this 2025 AFCON but CAF commot di hosting right from their hand say Guinea never ready na why dem carry am go Morocco.

• After 2027 Own wey Kenya, Uganda and Tanzania go host e sure me say na Morocco go host 2028 AFCON because dem go won prepare for 2030 FIFA World Cup wey dem won follow host and dem dey bid to host 2029 FIFA Club Worldcup also.

Morocco no come play ooo, CAF dey even tok say Sponsors plenty for this edition pass di previous ones and you want make dem commot for Morocco ?

Those people no come play oo, na we wey be Giant of Africa suppose dey show this kind doings wey Morocco dey do but🤦🏾

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message