UNKNOWN NUMBER SCANDAL IN NIGERIA - 7 months ago

Image Credit: Writer if the blog; Okonkwo Chiemerie Brendan

In my experience of unknown numbers, this story is my favorite. 

I'll try and carry the same humor my friend used to tell me the story. So pidgin English go necessary.

My friend narrated a call he had some days ago, how we got to that discussion is a story of it's own 

Anyways, the Tori begins…

 I dey scroll Instagram, finish dey watch film, so I  just wan rest small. Den, phone ring. Na one number I no too sabi. I pick am, "Hello?" From the other side, one heavy voice, like person wey don drink for three days straight, just shout, “My pikin! Na you be dis?! E don tey! I dey hear say you don turn big man for Lagos! You don forget us for village?”

My head was like, This is going to be interesting. "Sorry sir, who be dis?" Because we actually dey Lagos, but when I turn big man?

The voice laugh, “Hahahahaha! My pikin! Na Uncle Chinedu now! Your mama brother! You don forget your own uncle?”

Now, I know say I get one Uncle Chinedu, but dis voice... e just no fit. That man wey no fit shout to save em life. I try to remember if any other Uncle Chinedu dey, but nothing.

"Uncle Chinedu?" still confused. “Which Uncle Chinedu?”

Oga come vex, and that's when I got thrown off guard “Ehn! See dis pikin oh! Na me, Uncle Chinedu wey dey stay for Abia! We spoke last Christmas, you even promise say you go send me money for goat!”

Money for goat? At this point I'm not holding myself, laugh wan won wound me. I  never promise anybody money for goat! And my Uncle Chinedu na for Calabar e dey, no be Abia!

He wanted to continue rambling, then I just cut him off. “Come Sir, with all due respect, I think you dey call wrong number. My Uncle Chinedu no get dis kind voice, and e no dey stay for Abia. And I never promise anybody money for goat.”

Silence for the other side. Den, the voice clear throat, small small. "Ehn... oh... sorry oh! So you no be Nkechi pikin?" Was like  “No sir, I no be Nkechi pikin.”

Another silence. Den, the voice come small, small. “Oh... my bad oh. Dis network! E dey always confuse person. Abeg, sorry for disturb you oh.”

And the person just cut call.

Now I was not expecting that simple response, Now, normally you could tell if it's a scam when they keep persisting I don't know if the person dey disguise as my Uncle Chinedu just to get money for goat! Or maybe na true-true wrong number and one Nkechi pikin dey miss him own Uncle Chinedu.

But now, anytime my phone ring from an unknown number, I dey always remember the "money for goat" call. And i go just shake your head, knowing say for Naija, anything fit happen for telephone!

Na so the tori end.

What do you think my friend would have done? or do you think he handled this well?

 

 

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message