Do You Have Ulcer? This Is For You - Yesterday

🚨 “Oh,you thought It Was Ordinary Hunger…” Ulcer Wahala 😭

One day, you just dey feel small burning for my belle. You talk say na normal hunger.

Next thing? The thing turn full-time tenant 😭

📌 Wetin be Ulcer sef?

Ulcer na wound wey dey your stomach or intestine. E fit come from infection or when you too dey take painkillers like paracetamol without food.

⚠️ Signs wey no be joke:

Burning sensation for upper belle 🔥

Belle go dey pain you especially when you never chop

You go dey feel like to vomit

Plenty belching like say you swallow air

No appetite (food no go sweet you again 😭)

For serious case, you fit vomit blood or your poo go black

 

💊 How to handle am:

No dey skip food abeg (this one no be weight loss strategy 😭)

Reduce pepper, fried food, and too much garri soakings

No dey pop painkillers like sweet

Try rest, reduce stress (even though Nigeria no gree 😭)

Most important, go hospital! Doctor go give you correct drugs

 

💭 Real Talk:

That small pain wey you dey ignore fit turn something serious. No wait until your body shout before you listen.

🗣️ Make we gist:

You don ever ignore one symptom before and e later show you shege? 😭

 

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message