My People A Lot Dey Happen O - 6 hours ago

Image Credit: Football players

Meet Riccardo Merkuri di ASD Montemilone Pollenza player wey kpai imself thinking say e don kpai hin mama.

Di thing bin happen on di 20th of February 2026 wey be di boy 20th Birthday.

Riccardo Merkuri birthday bin dey go on when hin papa and hin people commot, so e remain di boy and hin mama( Albana Kastriot) for house.

As di two dey, naso quarrel start oo, di bobo begin beat hin mama oo, e beat hin mama ehh asin wonjure her face soety di mama dey unconscious.

Neighbor sef wey hear voice come begin dey call police and hin people make dem run come house.

Omo, as di bobo see say hin mama don dey unconscious e come think say she don kpai naso e keep hin phone for house drive reach Civitanova Marche come jump inside freezing sea, na from there e take kpai( dem see am through CCTV)

Naso di bobo kpai, hin mama sef don dey coma dey recover sha.

Wahala everywhere!!

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message