My Neighbor Love Wey Fall Yakata - 1 month ago

Last week Friday, I just dey my veranda jejely when Chinedu and his babe, Amaka, start quarrel.

Amaka dey shout, “So na my best friend you go carry go Chicken Republic?!”

Chinedu hold him head, “Babe, she just follow me chop rice, no feelings involved!”

Before anybody fit separate them, Amaka fling her wig like grenade  gbam!  the thing land for Chinedu motor bonnet.

Everybody for compound come out. Mama Blessing talk say, “This love don expire since August, una just dey do clearance sale.” 😂

By night, dem reconcile. By morning, dem dey fight again because Chinedu post “single and happy” for Whatsapp.

Attach Product

Cancel

You have a new feedback message