FBI don shoot and kpai one man wey bin dey hold plenti pipo hostage overnight inside one California bank.
Dis na according to di Bakersfield Police Department wey tok say dem kpai di suspect for "officer-involved shooting wey involve Federal Bureau of Investigation personnel" on Wednesday.
Di shooting na di end to a veri hectic time as di suspect bin lock imsef wit plenti pipo inside one multistorey Chase Bank building on Tuesday for Bakersfield.
At first, police bin go di area bicos of bomb threat.
Di suspects bin release two of di hostages on Tuesday during negotiations. Police say e free di remaining hostages on Wednesday and dem no harm dem.
Bakersfield mayor Karen Goh tok say she bin also dey monitor di situation.
Di tori comot on Tuesday, 2 June say one man hold plenti pipo hostage inside Chase Bank building wey dey for Chester Avenue and 17th Street, say di hostage taker carry bomb.
For statement, Bakersfield Police Department say dem receive call about bomb threat, say during investigation dem discova say di man barricade imsef inside di building wit several community members but nobodi don report any injury.
Di statement say police don establish perimeter around di building and oda surrounding businesses to ensure public safety.
According to di statement, some members of di community manage escape from di area on time.
Police bin don close roads wey lead to di area till further notice.
Meanwhile, police say dem don establish contact wit di hostage taker via phone and dem neva make any arrest.
Police dey tell community pipo make dem stay away from di area and stay safe while dem dey try do peaceful resolution to di case.
Police tok-tok pesin Sergeant Eric Celedon for video message say wetin happun na bomb threat but dem neva confirm or see any bomb.
Bakersfield na small city for Kern River, north of Los Angeles. E get population of less dan 500,000 pipo.
Tori be say some pipo inside di building dey hide away from di hostage taker.
Police dey work wit FBI to resolve di situation.