Wonders no fit end for this life oo, away from football..
This person wey you dey see here na Dayton Webber and di bobo na Cornhole player, e no get hand, e no get leg oo, guess what ?
Police arrest am on Monday say e use gUn kpai person and di name of di person wey e kpai na Bradrick Wells.
How e take happen be say, Dayton bin dey drive and e carry Wells for front with two others for back, before you know it, two of dem come begin dey argue oo.
Naso Dayton wey no get hand commot gUn shot Wells, as e shot am e drive enter one corner come tell those passengers wey dey for back say make dem help am carry di deadi bodi commot for hin car because e no get hand na.
Those ones no gree oo, naso dem run dey go call police, as police reach e come be say Dayton don leave hin car run, na track dem track am for hospital, e dey cell now.
Things dey happen, how that one go take tell hin forefather say na who no get hand kpai am.